Monday 29 October 2012

Lagos state wan construct bicycle lanes

To try give Niaja's most populous city effective transport system, the state government don announce plans to introduce bicycles lanes 4 major roads across the city. Na Commissioner for Transportation in Lagos, Mr Kayode Opeifa, cum mek diz announcement on Sunday at a cycling event ‘Park and Ride’ wer dey ncorage Nigerians to park their motor cum use bicycles xo dat their lifestyle and environment fit improve. Him yarn at the event wey him b the special guest, say “the bicycle programme don stat and say small tym, people go begin see some roads in Lagos wer dem mark as bike zones.” Him also talk say (commuters in Lagos) go dey use am go work, wen dem get to the bus stop them go tie their bikes to the poles wer government go provide at the bus stop and join BRT buses.” “The poles were government go provide at the bus stops no b for decorations but for people to tie their bicycles”. “4 d whole world, from London to Stockholm to Buenos Aires, people dey now use their bikes go work because e dey save environment of gaseous emissions wey dey harmful to environment.” Him also talk say cycling go enhance people health and also improve their productive and extend their lifespan which he claims will also have a resultant effect on the nation GDP.

No comments:

Post a Comment